Friday, August 16, 2013

K O B O K O [find content below]


See as life wipe me koboko, I begin dey dance.
As you laugh finish, my matter sweet you toh rehearse..  you no cun know sai mehn, chukkas love toh dance. talking drums wei be sai, den wan spoil her shoe reach france..she go carry dance show una say na all una teet, all of una mout wei cause am toh stumble upon quite a sweet romance.  So back to di remembrance of days wei breeze blow my yansh: a strike and many by life on me, wit immediacy I cun do etigi. all of una beat drum, I pass immigration. Now I laugh as I dey chop carviar. You sef still dey join mout laugh wit ur rolling belle wei sabi only garri and pepper. Dis your own laugh e don get temper now sha.
Shey na my matter you wan use do classic village festival. I nor get your temper nor time for a town crier. as life dey wipe me kobo, I just dance. So simple.. So sweet.. I cannot hide my teet.

[Pls follow this link to the video if you cannot access it on your mobile phone:]

2 comments: